MY PEOPLE, NO DECEIVE YOURSELF O! CONDOM NO BE 100% PROTECTION! > I know say you go shock! But make I tell you truth as your Warri Nurse... > > Condom dey protect well for HIV and pregnancy, BUT for some infections wey dey spread by SKIN-TO-SKIN contact, e no dey give full protection! > > *5 Infections Condom May Not Fully Prevent:* > 1️⃣ *Genital Herpes* > 2️⃣ *HPV* (Human Papillomavirus - fit cause cervical cancer!) > 3️⃣ *Syphilis* > 4️⃣ *Molluscum Contagiosum* > 5️⃣ *Pubic Lice* > > Because these ones fit spread even for area wey condom no cover! > > *So wetin you go do?* > ✅ No use fine face judge person health o! > ✅ Stick to one partner wey una two don go TEST > ✅ Get vaccinated — HPV vaccine dey very important! > ✅ If you see any sores, rashes, or itching, run go hospital, no dey hide am o #Viralpost #Viewers #Everyone #FertilityEducation #Fertilitysupport #Go Viral