Nurse Patience don para! Oga Jerry dey disturb Madam say "You no fit give me boy pikin." Madam Jerry don tire, she vex say "No be me cause am o!" My people, make we settle this matter once and for all TODAY! *HOW GENDER IS DETERMINED - Na Science, No Be Village People:* Listen well well: 1. *Woman (Mama) Egg:* Woman get ONLY X chromosome. Na X X. Every egg wey she go release na X. She get only one option. So she no get choice! 2. *Man (Papa) Sperm:* Man get X and Y. Na X Y. So for every time, im sperm fit carry X OR im fit carry Y. Na im get TWO options! Now the maths: - If Papa sperm wey carry *X meet Mama egg wey be X* = X + X = *(XX) = Usually Girl - If Papa sperm wey carry *Y meet Mama egg wey be X* = X + Y = *(XY) = Usually Boy So Oga Jerry, if you want football academy, na your sperm you go direct, no be your wife! #go viral #Everyone #Viewers #Fertilitysupport