TITLE: SECONDARY INFERTILITY NO BE WITCHCRAFT! ๐งโโ๏ธโ* Onos Family don enter wahala again o! *Mrs. Amaka (Mrs. Onos):* Nurse Patience, we don born one pikin, but now we don dey try for another baby, e no dey come! ๐ฉ *Mr. Onos:* Nurse, abeg check my wife well! Na she get the problem! Na she no fit born again! ๐คฆโโ๏ธ And Nurse Patience don para: > *"Oga Onos, you don turn doctor overnight? Make I tell you - Secondary infertility NO BE WITCHCRAFT!"* *WETIN BE SECONDARY INFERTILITY?* Na when couple don born pikin before (one or more), but now dem dey struggle to get belle again for more than 12 months of trying. *OGA ONOS, NA YOUR WIFE ALONE GET THE PROBLEM ABI? LIE!* See this man! Problem fit dey from: ๐น *MAN:* Low sperm count, infection wey dem no treat, lifestyle like smoking, drinking, age ๐น *WOMAN:* Blocked tubes from infection after last born, hormonal changes, age, fibroid, PCOS ๐น *BOTH OF UNA:* Stress, weight change ๐น *SOMETIMES:* Cause no dey clear sef! E dey happen. *NO BE VILLAGE PEOPLE, NO BE YOUR MOTHER-IN-LAW!* *WETIN UNA GO DO?* 1. *Two of una must go for checkup together!* No be only woman go waka. 2. Make una stop blame game and support each other. 3. Go see doctor early - infection wey dem treat early fit save your next pikin. 4. Make una live healthy. Mr Onos don learn today - e no be only Amaka matter! *Have you experienced this? Or you know somebody wey dey face this blame? Tag them! Make we stop the shame! #Everyone #Viralreels #Fertilitysupport #Everyoneactive