Rita
Rita@riri4

NO CALCULATE PAD, CALCULATE HEALTH ooo... WETIN BE FIBROID? Na non-cancerous growth wey dey develop inside or around womb. E no be cancer o! E very common for women, especially for Naija women. Some women get am, dem no even know! SIGNS WEY FIT MAKE YOU SUSPECT FIBROID:* 1- Heavy period — flow like River Niger, dey change pad every hour 2-Period wey dey last too long 3- Belle pain, heavy feeling for lower belle 4- Frequent urination — dey go toilet every time 5- Tiredness because of too much blood loss *Some women NO GET ANY SYMPTOMS at all! WETIN YOU MUST DO:* 1. *NO JUMP TO CONCLUSION!* Heavy bleeding no mean say na fibroid 100%. Only ultrasound and doctor assessment fit confirm am! 2. *NO USE HERBS OR MEDICINE ANYHOW!* No go buy agbo wey go cause more bleeding! 3. Treatment depend on your symptoms, size, and whether you still wan born pikin. No be every fibroid need surgery! 4. If you dey bleed too much, dey faint, or severe pain suddenly start — *RUSH GO HOSPITAL!* Abeg no hide your symptoms because of shame!* Go hospital make dem check you. Your health pass pad money! Share this make e reach every woman wey dey manage heavy flow for silence! #Everyone #Viralreels #Fertilitysupport

15 views0 likes0 comments