WETIN BE HYSTEROSCOPY?* Hysteroscopy na procedure wey doctor use one thin instrument with light and camera for him head — dem call am *HYSTEROSCOPE*. The size na like that of a biro pen or small straw. Doctor go gently pass am through your vagina, through your cervix, enter inside your womb (uterus). Inside the womb, the camera go send clear live pictures to a big TV screen. So doctor fit see inside of your womb directly — no guessing, no blind cutting! *No cut for belle! No big wound! No removal of womb!* *2. TWO TYPES DEY:* *A. Diagnostic Hysteroscopy (To CHECK):* Na to look only. Doctor wan find out wetin dey cause your problem. E dey last 10-20 minutes. Sometimes dem dey do am for office, you fit even dey awake. *B. Operative Hysteroscopy (To TREAT):* If for the diagnostic one dem see small problem like polyp or small fibroid, dem fit use special small instruments through that same hysteroscope comot am immediately. E dey last small longer — 30 mins to 1 hour. *3. WHY DOCTOR GO RECOMMEND AM FOR YOU? — THE REAL INDICATIONS:* This na why Madam for video need am, and why you fit need am: a) *Abnormal Uterine Bleeding:* You dey bleed too much, too long, or bleeding in-between periods, or bleeding after menopause. b) *Infertility / Difficulty to conceive:* To check if something inside womb dey prevent pregnancy to stick. c) *Recurrent Miscarriage:* If you don miscarry 2 or more times, make dem check if na shape of womb or scar tissue be the cause. d) *Suspected Polyps or Submucous Fibroids:* Na small growths inside womb wey fit cause bleeding and stop belle from entering. e) *Intrauterine Adhesions (Asherman's Syndrome):* Scar tissue wey join inside of womb together after infection or after previous D&C / abortion. f) *To locate and remove lost IUCD / Coil:* When coil lost inside. g) *Abnormal HSG Result:* If that tube test show something strange inside womb. #Viralreels #Everyone #Viewers #Fertilitysupport