LISTEN CAREFULLY — IF YOU DON DO FIBROID REMOVAL:* *1. ALLOW YOUR WOMB TO HEAL!* You no fit start to try for belle next week! Your womb get wound inside where dem cut comot the fibroid. If you put pregnancy immediately, womb fit rupture! Very dangerous! Doctor go tell you how long to wait — Usually *3 to 6 months, sometimes up to 12 months* depending on: - How many fibroids dem comot - Where the fibroid dey (inside womb wall dey take longer) - How deep dem cut enter womb *Ask your doctor: "Where my fibroid bin dey before?"* E dey very important for your next pregnancy plan! *2. ATTEND ALL YOUR FOLLOW-UP APPOINTMENTS!* No run comot after surgery. Go for check-up make doctor confirm say you heal well. *3. PLAN YOUR PREGNANCY WITH YOUR DOCTOR WELL!* After myomectomy, your next pregnancy NA HIGH-RISK PREGNANCY! You MUST tell your antenatal doctor say you don do fibroid surgery before. Many women go need *Elective C-Section (CS)* because of risk of womb rupture during labour. No be village people, na medical safety! *4. MYOMECTOMY NO BE GUARANTEE SAY BELLE GO ENTER SHARP SHARP!* Removing fibroid no mean say belle must enter next month. Other factors dey: your age, your tubes, your husband sperm, ovulation. But your chances don improve! *5. EVERY WOMAN CONDITION DIFFERENT!* Where your own fibroid dey, how big e be, and how your womb heal — na wetin go determine your own journey. #Viralpost #Everyone #Goviral #Viewers #Fertilityeducation