Rita
Rita@riri4

WETIN BE PCOS?* PCOS means *Polycystic Ovary Syndrome.* No be say your ovary don spoil. No be cancer. No be infection wey man give you. Na *HORMONAL IMBALANCE* — meaning your body hormones no dey balance well. Normally, every month, your ovary suppose release ONE mature egg (ovulation) — na that egg go meet sperm make belle enter. For PCOS woman, because hormone don scatter, the ovary dey produce many small small immature eggs (cysts) wey no gree grow and burst. So ovulation no dey happen regularly. If egg no comot, belle no go enter! That na why period go dey miss, or dey come once in 3 months, or dey come anyhow. *2. HOW YOU GO KNOW SAY YOU GET PCOS? — THE SIGNS:* No be only one sign. Doctor go check if you get at least 2 of these 3: *A. Irregular Period:* Period no dey come regular, e dey skip months, or e dey come too much. *B. Signs of Too Much Male Hormone (Androgen):* — Beard / hair for chin and chest like man, serious pimples/acne wey no gree go, hair dey fall for head. *C. Polycystic Ovaries for Scan:* When dem do ultrasound, dem go see plenty small small cysts for ovary like bead. Other signs: Difficulty to lose weight, weight dey add anyhow, dark patches for neck/armpit, difficulty to get pregnant. *3. WHY PCOS DEY CAUSE INFERTILITY?* Because *NO OVULATION = NO EGG = NO BELLE.* E no mean say you no get eggs. You get eggs PLENTY! Dem just dey stuck! Dem no dey mature and comot. #Viralpost #Everyone #Viewers #Fertilitysupport #Fyp

59 views2 likes0 comments