1. PCOS FIT THICKEN YOUR WOMB LINING — NA SERIOUS MATTER!* *Nurse Patience: "It also increase the risk of thickening of the womb lining when periods are very irregular."* Listen well! Normally, every month, your womb lining go build up, then when period come, e go shed comot. That na how body dey clean itself. For PCOS woman wey period no dey come for 2 months, 3 months, 6 months — that lining no dey shed! E dey continue to dey build up, build up, build up inside womb. If e thicken too much and stay too long without shedding, e fit turn to *Endometrial Hyperplasia* — wey if dem no treat am on time, e fit later turn to womb cancer! Na why Doctor go dey worry when your period dey miss too much. E no be just "my period no come, I happy, I don save pad money." NO! Your womb dey gather dirt wey suppose comot! If your period dey miss for more than 3 months, abeg go hospital. Doctor fit give you medicine to bring period comot and clean the womb. No dey happy say period no come! *2. PCOS & SUGAR / DIABETES — DEM BE TWINS!* Many women with PCOS get *Insulin Resistance* — meaning their body no dey use sugar well. Sugar dey stay for blood too much. Na why PCOS woman fit: - Add weight anyhow, especially for belle - Crave sugar, dey hungry every time - Get dark patches for neck, armpit - Later develop *Type 2 Diabetes* if dem no take care Na why for this video, Nurse Patience mention *HbA1c and Oral Glucose Tolerance Test (OGTT).* Doctor go check your sugar level to know if your body don dey enter diabetes zone. So PCOS na not only fertility problem, na *WHOLE BODY PROBLEM* — womb, sugar, heart, weight, everything! *3. PCOS & EMOTIONAL STRESS — THE HIDDEN PAIN!* *Madam for video: "I don't tire to dey jump from one hospital to another..."* My sister, we hear you! 😭 PCOS no be only physical. E dey affect mind: - You dey fear say you no go born - You dey shame say beard dey grow for your face, pimples full - You dey depressed because weight no gree go - You dey tired to dey jump f…