Low ovarian reserve PT2 What is AMH?* AMH na test wey dey show doctor how many eggs remain for woman ovary. *Low AMH mean wetin?* E mean say the number of eggs don reduce. E no mean say the eggs no good. *Low AMH NO mean:* - No mean say you no fit get belle naturally - No mean say your womb don close - No mean say hope don finish *Wetin matter pass?* Your age. Age fit tell us more about your chance to get pregnant than AMH alone. AMH dey mostly help doctor know how your body fit respond if you do IVF. *Remember this:* Fertility na work for two people. No be only woman suppose do test. Husband and wife must both check, because problem fit come from either side or both sides. My sister, no use fear go take herbal mixture or random fertility drugs. No let anybody use low AMH frighten you or judge you. Low AMH no automatically mean no baby. If them tell you say your AMH low, abeg see a proper doctor, ask questions, and take am one step at a time. Share this video to that woman wey need am. You fit save her from fear today. #Everyone #viewerseverywhere #Viralreels #Fyp #Wanoteam #fertilitysupport